Wia dis foto come from, Getty Images
2024 na year of trendy slangs. From "No gree for anybody" wey appear to set serious tone for di year, to funny ones and to odas wey be just pure vibes.
Dis trendy slangs bin pop up from anywhere. Some bin come from social media, music, movies or from old television.
Na evri year slangs dey drop as e dey form part of everyday conversation among Nigerian pipo.
From funny yarns on hardship to cunny ways of catching cruise on top social media. These slangs dey show di creativity of Africans, and how dem dey use dem lighten dia mood and cope wit di economic hardship for di kontri.
Di slangs wey trend for 2024 show street credibility and smartness. Although, no be evribody like to dey adopt street slangs, but e dey sometimes influence how we take dey yarn wit oda pipo.
Dis na some of di slangs wey trend for Nigeria, Ghana and all ova di world for 2024.
2024 start wit dis banger, "No gree for anybody", wey fit mean say no allow anybody cheat, bully, intimidate or harass you. E also fit mean say no settle for less dan wetin you deserve.
Di origin of di slang dey hard to trace, but some sources suggest say one gospel song wey di title na "I No Go Gree" by Sister Agatha Moses for her album "Thank You" fit be wetin inspire am. Di song, wey she release for 2003, bin get one chorus wey she take repeat di phrase "I no go gree" ova and ova again.
Di slang bin go viral for di early part of di year for Nigeria bicos many Nigerians fit relate wit am.
Di phrase "Very Demure" start to dey trend afta one popular content creator for TikTok, Jools Lebron post one video on 5 August about how she dey approach her work and her make-up.
Di video bin start for inside her motor as she tok say, "You see how I dey do my make up for work? Very demure, very mindful."
Di video bin gada ova 30 million views and she now get ova 1.5 million followers for TikTok.
Since dat time, di slang don blow up worldwide wit ova 200,000 posts wia dem don use di hashtag and oda videos wey dey tok about how to act "very demure" for situations.
Meanwhile, 'demure' na word wey dey describe woman wey dey quiet, reserved and modest.
Dis na one slang wey go viral and even turn challenge on social media.
Some pipo claim say di slang start for TikTok. How e dey work na like say two or more pipo go spill out secret dem know about di oda pesin. Dem only dey allowed to listen, dem no fit judge.
Di video of di trend go show pipo wey go tok say "We listen and we don't judge" di same time, bifor dem begin dey spill secrets wey dem bin hide from each oda.
Couples, relationship pipo, best friends, co-workers and even family members don jump on dis trend.
Di word "Steeze, na slang term" wey be mixture of "style" and "ease," e mean to look effortlessly cool, charisma and to describe pesin wey carry grace.
E originate from snowboarding and skateboarding, wia athletes dey perform tricks wit natural flair.
Now, dem dey use am for fashion, music, and everyday tok, as e describe pesin wit relaxed and confident style.
E really gain popularity for Nigeria during di 2024 Ojuode Oba festival for Ijebu-Ode southwest Nigeria, wen camera capture one man Farooq Oreagba wey steal di show wit im full traditional regalia as e ride majestically on top horse. Di foto bin go viral and e earn oga Farooq di title "King of Steeze".
Di slang get religious connotation wey show sense of self-importance or to claim special status, e dey imply say pesin dey special or favoured.
E become popular afta video clips of some controversial testimonies from di Lord Chosen Church.
Dem dey use dis slang to show wen pesin do something very well.
For instance, if pesin dress well or if e set well, dem go say e ate di look wit di cloth, wig or makeup e use.
No be about looks only, if e tok well, sing well, act for movie well or work well, dem go use di slangs describe am.
'Ozeba' mean trouble maker and na popular Nigerian musician Rema 'Divine Ikubor' make di word popular wit im song 'Ozeba' for im latest album.
Benin pipo for Edo state dey use di slang for pesin wey wan go cause kasala.
Oda slangs wey trend for Nigeria include 'Go hard or go home, No Panic, Go warm eba, among odas.
Apicki – Dem dey use dis slang if something dey successful. Di term become popular from king Paluta song "Apicki".
Jejereje – Mean cup of tea. E start dis year from Stonebwoy song wey di title na Jejereje.
Sankofa – Di slang mean to go back to something you don comot hand from.
Dat's on Purr – Na Gen Z dey use dis slang pass. E mean dat's on period. Dem dey use dis term to lay emphasis on something and dem no go change dia.
© 2025 BBC. De external site no concern BBC. De way wey we de take go external link.
Leave a Reply