Wia dis foto come from, Instagram/Shade.Okoya
Recently di sons of one of Lagos businessman and industrialist, Chief Razaq Okoya bin enta social media afta video show wia one police man bin dey hold bundles of cash for dem.
Chief Okoya na ogbonge businessman wey dey popular for im home-friendly products wey di company wey e get dey produce.
But for some Gen Zs, di Chief Okoya name fit no ring loud bell for dia ears, not until im two sons Wahab and Raheem show for video wia dem dey show bundles of naira.
Di video cause some controversies while some even question why policeman go dey hold money for dem as dem dey dance for di video wey go viral for social media.
But who be Chief Razaq Okoya?
Wia dis foto come from, X/NigeriaPolice
Bifor we look who dis ogbonge businessman, Chief Okoya be, make we look wetin im sons do wey make dem dey trend for social media.
Inside one viral video wey social media pipo begin dey share around dis week, two of Chief Okoya sons, Wahab and Raheem, bin dey display bundles of money.
Dem even hand di bundle of money to one police officer wey stand beside dem as dem dey dance wit dia white flowing agbada.
For inside di video, di two sons dey dance and spray money on each oda, an act wey pipo don describe as abuse of di naira notes.
Although naira scarce for some part of Nigeria, especially Lagos, but di kain naira notes wey Wahab and Raheem dey spray na new notes wey still dey inside nylon as bundles.
However, one big controversy wey follow di video na di police officer wey dey hold money for dem while standing in one position.
Social media users accuse di police say dem dey work for di two sons unprofessionally.
In reaction to di video, di police through dia tok-tok pesin, Olumuyiwa Adejobi, say dem don identify di police officer wey dey hold money for Chief Okoya sons for di viral video.
E add say di police officer go face disciplinary action.
"Di policeman wey dey captured for di recent viral video wey di sons of di Lagos businessman, Chief Okoya, bin share wia dem dey abuse di naira, don dey identified and detained for disciplinary action."
Di police say di police officer wey dey hold money for di viral video no do well and dem condemn di action as dem go work to uphold di values of di police.
For anoda angle, some begin question why na only di police officer dey face disciplinary action wen be say di video clearly show di two Chief Okoya sons dey spray money.
Meanwhile, e no long as di palava dey go on wen Raheem Okoya post for im X account on Friday 10 January, 2025 say e dey sorry for wetin happun as im no mean to cause any harm.
E add say im 'intentions dey pure and ask for forgiveness' as e claim say e no sabi di consequences of im action.
Wia dis foto come from, Instagram/Shade.Okoya
Chief Razaq Okoya na businessman and founder of di popular Eleganza Group of Companies.
Plenti Nigerians wey dem born for 1990s go remember say different houses go get at least one Eleganza product – e fit be bucket, cooler or chair.
Di Eleganza company na one wey e found many years ago and e grow am into a ogbonge venture wey kon get different branches.
Dem born Chief Okoya for 1940 and e go be 85 years old by 2025 – e don dey around for ova 8 decades.
Chief Okoya come from di Yoruba race from di southwestern part of Nigeria. Dem born am into di Okoya family for Lagos State, southwest Nigeria.
Tori put am say Chief Okoya grow from a tailoring background sake of say na di business wey im father dey do be dat. Wit dat knowledge, e begin business on im own.
For 2015, Cresent University bin confer on Chief Okoya a doctoral degree of Doctor of Science (Honoris Causa) for Business Administration.
Interestingly, Chief Okoya dey conferred wit Nigeria National Award of Commander of di Order of di Niger (CON) amongst oda ogbonge awards.
For 1999, Chief Okoya bin marry Shade as im youngest wife and for over 25 years dem dey married wit children. She dey serve as di CEO of Eleganza Group.
E also get senior wife Kuburat wey dem dey married for 50 years.
Wit im business mindset, Chief Okoya don show for public wit big men and popular politicians wey include President Bola Tinubu, Govnor Babajide Sanwo-Olu, Sijibomi Ogundele, wey dem sabi as Sujimoto, veteran broadcaster Bisi Olatilo amongst odas.
© 2025 BBC. De external site no concern BBC. De way wey we de take go external link.
Leave a Reply